ads

Slider

News

Airtel

Airtel
Real Data

Entertainment

Gist

Sports

Business

SAD!

If i dey insult and yab our
Government,many people go feel say,i dey
carry yarn,becos maybe dem dey benefit
from the Government,so dem nor wan hear
any wrong thing about the Government.
The parents of this wonderful kids don get
other Children but d woman dey find Girl
pikin. Na so God come throway two Girls
give her according to SCAN wey she do.
After many hours for Labour for Sapele
General Hospital. Doctors cum find out say
if one of the child dey push come out,say
something dey drag her back dey go inside.
So them cum prepare the Woman for C.S.
My people before God and Man,na "Cojoin
Twins" nai d woman produce. After them
bring down the children,nai dem contact
me,say them get major issue wey pass
them for the Hospital. Before i reach the
Hospital,i don put on all my Transmitting
machines and CCTV camera's. My dear
people of Sapele from the hour of
delivery,these children nor last reach
2Minutes,before dem give up. WATER
ALMOST FINISH FOR MY EYES. How on
earth person go carry pregnancy for
9months,only for her to deliver wetin our
Health sector nor fit protect? Wetin cum be
the need of the Hospital without basic
facilities? E don tey when i dey complain
say Sapele General Hospital nor get simple
Oxygen and other facilities to meet up our
present health challenges,but nobody dey
give listening ears. When i reach the ward
to go examine the Babies,i cum find out
say,na Oxygen dem say,dem use sustain
the kids or else dem for die earlier than the
period wey dem stay. If we look well for
deir pictures under,we go see say,somebody
hold oxygen dey inter-change am for the
babies to gasp in air to survive. From dis
picture,unu go agree with me say,na lack of
equipment nai kill dis children becos if the
two kids get deir individual Oxygen i nor
think say,dem for ever die fast at all,if at
all say dem go die for dis tender age.
How a whole SAPELE GENERAL HOSPITAL
nor go get Oxygen? Report reach us say
our Governor pronounce say Delivery na
free for all pregnant women,but if you
mistake enter Labour for 30minutes,the
baby norva cum down,the wicked nurses
wey dey General go just begin dey abuse
patients,before u know,them don refer you
for C.S,and after the d delivery dem go
charge you almost N40K. How dat one cum
take be free?
I don dey talk am before say na who get
something nai suppose know the value. Our
Community Leaders wey suppose use deir
influence beg Companies to donate some of
dis facilities to our Hospital refuse to talk.
Na to chop land money nai concern unu.
When i research about Cojoin twins i cum
find out say to separate dem dey hard in
most cases becos them dey mostly dey
share dsame Kidney,Heart,Liver and other
human parts. Most especially when dem
gum eachother from the Belle side. But dem
dey survive and leave well among us.
Cojoin twins don become Minister of
Health,Engineers,Doctors and other
professioner jobs,wey contribute deir own
quarter to the betterment of the world.
Though i know say we still dey behind to
handle such issues but the kind money wey
dis Government dey put into Health and
where as nothing dey happen,dey very
alarming. I dey very sure say the only
Oxygen wey General Hospital manage
get,nor even dey in good working order and
nai make we quick lost this children.
Today i dedicate this morning to dis our
priceless kids wey God use take test our
medical sector and expose deir anus. As i
call on all of us for dis forum to pray for
deir Souls. Them deliver the children on
Friday wey pass so and dem die dat same
friday for same Sapele General Hospital.

Source LIB.

About Unknown

This is a short description in the author block about the author. You edit it by entering text in the "Biographical Info" field in the user admin panel.
«
Next
Newer Post
»
Previous
Older Post

No comments:

Post a Comment

Please share your thoughts;Let us know what you think about this post.


Top